Zlatan Ibile Opens Up On How Big Wiz Credited Him #22M To Support His Clothing Brand.
According to Zanku Crooner, Zlatan Ibile, he made shocking revelation on how he got massive support from influential people across Nigeria.
"When I first open my clothes brand, I no even expect the kind love wey I see. Na just passion and street motivation push me enter the game. I wan drop something clean, something the streets go wear with pride Zanku drip, you understand?
Next thing, celebrities begin show up steady. Big names. People wey me sef dey look up to. Dem come through, rock the brand, show me real love. I no go lie, the energy choke! I dey reason say, "Ah ah, na like this e easy?"
But the one wey burst my brain pass… one evening like this, I dey chill, my phone ring. Dem say make I check alert. I open my phone… 22 million naira from Big Wiz I just dey look my phone like say na prank. Baba bless me from him heart without long talk. No noise. Just pure love and respect. That moment change everything for me. E show say if you dey work hard, dey real, people go see am and support you.
Na why I dey always tell people make you no give up. Hustle legit, put in work, carry your people along. You no know who dey watch you. One day, the blessings go drop like rain". He Said.
Post a Comment